Posts

Showing posts from February, 2022

FROM DE VERY BEGINING

You see dis tin wey dem dey call NARCISSISM eh... I been no know how serious wey dis evil dey, until recently. No be say I neva hia de word before, but all dis while wey I tink say I sabi blow grammar, I know get idea how serious dis strong and devilish word mean. Not until I just dey for youtube, and come jam one video about dis word, na so my eye just open waaaaaaa... So make I break am down for dos wey no know, narcissism na when pessin wey no get consience at all begin transfer hatred to people wey dey around am. Dat pessin na pessin wey for im mind im no know anytin like sympathy or feeling. No be say de pessin no fit feel am, de pessin just no know how to dey good. Na serious mental condition. Dem dey call dat kind pessin NARCISSIST. I shock when I find out dis tin, and why I shock be say afta I discover dis tin, I come realize say dis kind people dey well well for my family. I mean very close family members. All my life I don suffer for dis kind people hand. And I dey always wo...