FROM DE VERY BEGINING

You see dis tin wey dem dey call NARCISSISM eh... I been no know how serious wey dis evil dey, until recently. No be say I neva hia de word before, but all dis while wey I tink say I sabi blow grammar, I know get idea how serious dis strong and devilish word mean. Not until I just dey for youtube, and come jam one video about dis word, na so my eye just open waaaaaaa...

So make I break am down for dos wey no know, narcissism na when pessin wey no get consience at all begin transfer hatred to people wey dey around am. Dat pessin na pessin wey for im mind im no know anytin like sympathy or feeling. No be say de pessin no fit feel am, de pessin just no know how to dey good. Na serious mental condition. Dem dey call dat kind pessin NARCISSIST.

I shock when I find out dis tin, and why I shock be say afta I discover dis tin, I come realize say dis kind people dey well well for my family. I mean very close family members. All my life I don suffer for dis kind people hand. And I dey always wonder why dem dey like dat. Even sef I dey tink say na me wey dey at fault when make dem dey treat me de way dem dey treat me.

My dear I don suffer no be small. I don cry tire. Anytime I go begin tink about how much evil dis people wey I call my people go dey treat me like rag ee dey pain me welal well. Chai!!

Dis blog wey I dey write, I wan use am as a way to release de pain wey dey inside me, so dat I go heal. And I also wan bring attention to dis mata to we wey dey for dis side of de planet. You know say most of us no dey chook eye for anytin wey concern mental health. And na so we go dey die in silence and dey call on God for even tins wey we fit solve awa sef.

Make una no vex with me too much anytime you come tink say I dey misyan for any write-up. Dis na because I fit no dey professional for de way wey I take arrange my tinkin, but na my heart I wan to dey pour out for dis blog. And if you find out anytin wey no correct for any topic wey I write about, abeg no waste time to correct me. 


Thank you well well.

Comments